Nigeria vs South Africa highlights: Dele-Bashiru rescue Finidi George as Super Eagles 2026 World Cup chance dim - BBC News Pidgin (2024)

Wia dis foto come from, Getty Images

Di Super Eagles of Nigeria bin fail to beat di Bafana Bafana of South Africa for di 2026 Fifa World Cup Qualifier wey happun for Uyo.

Dis na di third unbeaten for South Africa as Nigeria fail to beat dem again for home soil, Uyo, di Akwa Ibom State capital.

South Africa go play Zimbabwe for dia next game for di World Cup qualifying matches for Group C.

Afta a fruitless 28 minutes of play between di two teams, Zwane put di ball in play wit a beautiful strike wey drop for di back of Super Eagles goalkeeper Stanley Nwabali.

Di scoreline change as South Africa take di lead wit a one goal difference as Super Eagles dey struggle for a goal.

Skip Recommended articles and continue reading

Recommended articles

  • Nigeria, Ghana, Morocco, kontris 2026 World Cup qualifiers squad list

  • Nigeria record major win over Ivory Coast to boost chance for Afcon 2023

  • Why pipo dey slump and die during football match and how you fit watch safely

  • Nigeria struggle wit Lesotho for dia first 2026 world cup qualifying match

End of Recommended articles

Ademola Lookman and Alex Iwobi play togeda to try find di back of di net for first half but dem no fit and South Africa goalkeeper Williams dey kampe.

Di first half bin end wit South Africa leading.

Surprisingly, few seconds into di second half, di Super Eagles equalise wit a beautiful strike from Fisayo Dele-Bashiru afta di correct assist from Alex Iwobi.

At dis point, Super Eagles coach Finidi George begin dey smile for di touchline.

Di second half show a change of game for di Super Eagles wit dia energy to find more goals to lead.

Wen Chukwueze come in, im try create some chances but none turn to goal.

Mokwana and Tau na two star players for South Africa but dem also no score.

Nwabali dey confident for di goalpost and Tanimu hold di right-back correctly.

Unfortunately, di two teams no see any more goal till di match end.

Super Eagles coach Finidi George defend why im no use Victor Boniface for di match.

“We bin think about to bring am in, e suppose to come in, but wen we hear Ajayi complain say im no fit kontinu we gatz change our plan” Finidi tok for im post-match conference.

Currently, Lesotho dey lead di Group C wit Rwanda for second position. Nigeria dey 5th position but dem go face Benin for dia next game while South Africa wey dey 4th position go face Zimbabwe wey dey bottom of di group.

Nigeria vs South Africa highlights

FULL-TIME: Nigeria 1 - 1 South Africa

SECOND HALF

Williams wit di ball for goalkick.

90+4mins- Mudau trying to create chance for South Africa. lookman move wit di ball again, finding whom to pass give.

Iwobi gets di ball, turn round and try to shoot but e play am go up.

90+3mins- MOFFI lose dat ball. e for be a lead for Nigeria ooo.

WHAT A SAVE by Williams. Corner for Nigeria as Williams jump to catch di ball.

90+1mins- Stanley Nwabali dey post to catch di ball. Lookman take di ball, swing into di side, hit wit a shot- but di goalkeeper push am.

5Mins Added Time

90mins: Nigeria is putting some pressure but e neva turn to goal

Great touch by Tanimu wit a pressure

88mins: Great touc by Lookman as di Super Eagles dey in control. Mokoena take di ball.

Zwane is out for South Africa.

Nice pass to Lookman but poor finishing

86mins: Di crowd dey cheer di players. Lookman take di ball, move it closer, hit di ball but Misbau block am

85mins: ball is back in play. Lookman neva bring im Europa Leageu final skills come dis pitch.

83mins: Bassey win di ball, put it in play for Nwabali wey later launch am out. Some South Africa players dey tire. Mvala dey gas out for di pitch and diplay dey on HOLD.

81mins: GREAT STRIKE by Lookman but blocked by Ngezana and Mudau. corner taken by Lookman very fast. Nigeria building pressure.

More pressure on Williams from di Nigeria side, but e no too shake. Ball in play.

79' SUBSTITUTION: Ajayi out, Onyedika in for Nigeria. Onuachu out, Toffi in

78mins: What an overlap from di Nigerian players, Tau and Sithole square play but who shoot, oh no, no way.

South Africa dey try make move as Sithole dey find chance for a long shot to hit Nwabali

76mins: A little bit of stop sake of di South Africa player wey injure

WHAT A MISS for Nigeria. Chuwkueze collect pass from Iwobi, move to di post to collect di ball back as im tip am for di top of South Africa goalkeeper but e hit di bar and bounce back.

74mins: What an incredible for Tau, will he score? Oh no, ova di bar. Im get free space to move and shoot inside Nigeria net

72mins: Iwobi wit di ball, move a bit, thinking of wetin to do wit di ball, oh no, indecision make Bafana Bafana attack di ball comot from im hand

Whaatttt a Miss!! Osayi-Samuel no hit di ball well for inside box 18.

70' SUBSTITUTION for South Africa. Apoollis in for South Africa, Mokwana out. Rayners also out, Foster enta

Sithole make a good run. But Nwabali run come out to clear di ball

Both teams dey find goal to lead di game. Mokwana try a low shot but e no dey effective.

Nigeria 1 - 1 South Africa

68mins: Chukwueze play correct ball, give pass to Yusuff but e lose am, but still wit Nigeria. Chukwueze working so hard to get di ball back

SUBSTITUTION- Chukwueze in, Iheanacho out for Nigeria

Tau run wit di ball but e go corner

65mins:Ndidi find Lookman for di 18 yard but e no convert am. Tau dey try break Nigera midfield but Bassey and Iwobi dey stop am

63mins: Zwane give correct pass but na offside for South Africa

61mins: Lookman take di corner, Bassey try struggle for di ball, but e no dey enough. Nice counter attack by Zwane but im no fit complete am

SUBSTITUTION Deel-Bashiru is out, Yusuff enta

60mins: Correct ball from Iwobi. Osayi-Samuel wit di ball, e find Lookman, Lookman find Osayi-Samuel again. ball go to corner for Nigeria

58mins: Ball is back in play. Sithole and Tau on a great move towards Nigeria goalpost

Dele-Bashiru is down. dem carry am comot for pitch as im dey limp.

56mins: Great run by Mokwana wey dive right into di Nigeria box 18, but di ball dey stopped.

YELLOW CARD for South Africa. Ngezana get booked for foul

54mins: Ball is back in play, Mvala dey try dribble into Nigeria defence

Dele-Bashiru is down afta colliding wit South Africa defender

52mins: Correct run by Dele-Bashiru into di box 18, im fall for box 18 but referee no blow. Ball in possession

FREE KICK for Nigeria. Lookman take but Onuachu don go do foul for di box 18.

50mins- Jersey number 21 dey try complain give di referee.

Finidi George don dey show some smile wey di Super Eagles don equalise.

48mins- Iwobi dey do great assist for di Super eagles. Amazing start for di secon half. 23yrs old Dele-Bashiru don make di score equal.

Nigeria 1 - 1 South Africa

Dele-Bashiru score for Nigeria

46' GOOALLLLLLLL!!!

First Half

Nigeria 0 - 1 South Africa

Half- Time

Nigeria dey pressure South Africa but no chance to fire at di goal post

45+2mins: Lookman get chance but im no convert am agaim. Osayi-Samuel dey dribble but no finishing

Finidi George dey follow Iheanacho tok bifor half-time go come.

3mins ADDED TIME

Nice crossing from Lookman to Onuachu wey give am correct header oh, but di header no too strong as e land for Williams front-- e catch am

Nigeria 0 - 1 South Africa

40mins: Foul, dem fall Lookman down. Nice pass between Iwobi and Lookman, but im no fo well. Good shot by Ndidi for Nigeria.

Jersey Number 17 for South Africa almost put anoda goal for post oooooo. Wetin Nigeria defenders dey do like dis

38mins- Goalkick for South Africa- Finidi George dey look di kain miracle wey go happun.

Ndidi dey play well for di middle as im dey supply good pass give Iwobi

36mins: Corner punched by Nwabali. Great run by Ajayi but Williams don catch di ball already

CORNER for South Africa

Oh, what a save by Tanimu. Nwabali bin lose di ball afta sliding

34mins: Mokoena and Sithole dey try create chances for South Africa but Iwobi stand gidigba to dey clear anytin comot for dia legs

32mins: FREE KICK to Nigeria. To be taken by Iheanacho. But im play am wide bifor Bassey go fit reach touch am for back of net

YELLOW CARD. Di first card of di match to jersey number 6.

30mins- Nigeria coach Finidi George don stand from im chair wit heavy eyes

Nigeria 0 - 1 South Africa

South Africa don score. Zwane score wit a brilliant strike

29' GOALLLLLLLLLLLLL!!!

27mins: Oh, what a nice crossing from Ndidi, but na straight into di hands of Williams South Africa goalkeeper.

Nigeria dey get throw-in opportunities.

Dele-Bashiru dey show skill for Super Eagles. Long throw by Tanimu.

25mins: Nwabali get confidence for post as im catch di corner come still do long shot.

CORNER for Bafana Bafana

Nice ball clear by Iwobi at di goalpost, as Nwabali too dey show im goalkeeping skill

23mins: Di Bafana Bafana dey give dia goalkeeper well so im go fit launch but Lookman stand wit am.

Ademola Lookman, di Atalanta star dey give some correct dribles but di ball don go gooalkick bifor im pass am.

21mins: Lookman take di free kick, put am for middle but no Super Eagles player dey to shoot am inside post.

FREE KICK for Nigeria.

Nigeria wan create chance for di middle but e no show

19mins- Nice run by di Bafana Bafana jersey 5, good run, oh no, di linesman say na offside.

Keeper to keeper shot from Nwabali to Williams

Osayi-Samuel dey give serious defending for di Super Eagles.

17mins: Nice run from Number 17 of di Bafana Bafana but Nwabali stop di ball.

15mins: Jersey number 11 play di free kick for South Africa but na ova di bar as Nwabali no even too stress im sef to fly.

FREE KICK for South Africa

What a long shot for di Bafana Bafana. Defenders stop am and referee blow foul

13mins: Mvala and Modiba dey find correct midfield pass for South Africa

CORNER for South Africa afta Tanimu fire di ball comot from post

10mins- Ademola get di ball, im make sweet move but, chaiii, im no fit shoot go di post

Oh nooooo, South Africa for don score wit dat hot shot but Nwabali block am referee blow

Di Bafana Bafana player dey play correct ball

9mins: Anoda fine play by Lookman for South Africa Box 18 but im no fit convert di chance to goal

Nice touch from Lookman, im move a bit but, oh nooooo, he fire am wide ova di post

7mins- Osayi-Samuel wan try create some chances but South Africa defenders stand wit am.

6mins: OFFSIDE run by jersey number 17 for South Africa. Referee raise di flag

4mins: Nigeria dey put ball in possesion as Bassey dey hold di back well. Ajayi no gree for South African players. Nwabali dey confident for post.

2mins: Chance for Nigeria, but di header by Onuachu no gree enta

FREE KICK for Nigeria by Iheanacho

Nigeria take first throw-in

1 min: Nigeria kick off di match

Match don start

Starting XI

Nigeria IX: Nwabali, Ajayi, Bassey, Tanimu, Osayi-Samuel, Dele-Bashiru, Iwobi, Ndidi (C), Iheanacho, Lookman, Onuachu

South Africa IX: Williams (c), Mudau, Ngezana, Mvala, Modiba, Mokoena, Sithole, Tau, Zwane, Mokwana, Rayners.

Nigeria vs South Africa highlights: Dele-Bashiru rescue Finidi George as Super Eagles 2026 World Cup chance dim - BBC News Pidgin (2024)
Top Articles
Latest Posts
Article information

Author: Mr. See Jast

Last Updated:

Views: 6394

Rating: 4.4 / 5 (55 voted)

Reviews: 94% of readers found this page helpful

Author information

Name: Mr. See Jast

Birthday: 1999-07-30

Address: 8409 Megan Mountain, New Mathew, MT 44997-8193

Phone: +5023589614038

Job: Chief Executive

Hobby: Leather crafting, Flag Football, Candle making, Flying, Poi, Gunsmithing, Swimming

Introduction: My name is Mr. See Jast, I am a open, jolly, gorgeous, courageous, inexpensive, friendly, homely person who loves writing and wants to share my knowledge and understanding with you.